Published 4 years ago in Jazz, in album: Sweet Mother

Sweet Mother

  • 138
  • 0
  • 0
  • 0
  • 0
  • 0

Original Release Date: October 26, 2016
Release Date: October 26, 2016
Label: ROGERS ALL STARS NIG LTD

Lyrics

Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
When I dey cry, my mother go carry me,
She go say my pikin weti you dey cry o yo
Stop stop, stop stop, stop stop make you no cry again
When I want sleep, my mother go pet me
She go lie me well well for bed
She cover me cloth, sing make you sleep
Sleep sleep my pikin oh
When I dey hungry, my mother go run up and down
She dey find me something wey I go tchop oh
Sweet mother, sweet mother oo
When I dey sick,
My mother go cry cry cry
She go say instead when I go die, make she die oh
She go beg God, “God help me, God help me, my pikin oh”
If I no sleep, my mother no go sleep
If I no chop, my mother no go tchop
She no dey tired, Sweet mother
I no go forget this suffer wey you suffer for me
Sweet mother, éé sweet mother oo
Sweet mother I no go forget this suffer wey you suffer for me. And if I fi forget you,
therefore I forget my life. If you forget your mother, you’ve lost your life
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
When I dey cry, my mother go carry me,
She go say my pikin weti you dey cry yé yé
Stop stop, stop stop, stop stop make you no cry again
When I want sleep, my mother go pet me
She go lie me well well for bed
She cover me cloth, say make me sleep
Sleep sleep my pikin oh
When I dey hungry, my mother go run up and down
She dey find me something wey I go tchop oh
Sweet mother éé, sweet mother éé
When I dey sick,
My mother go cry cry cry
She go say instead when I go die, make she die oh
She go beg God, “God help me, God help me, my pikin oh”
If I no sleep, my mother no go sleep
If I no chop, my mother no go tchop
She no dey tired, Sweet mother
I no go forget this suffer wey you suffer for me yé yé
Sweet mother, sweet mother
You fit get another wife, you fit get another husband
But you fit get another mother? No, at all.
Sweet mother, I no go forget you
For this suffer wey you suffer for me
Sweet mother, sweet mother …..

::
/ ::

Queue

Clear